AfroFlavor presents “Siri Cast Me” by Holuwa, a powerful Afro-Gospel song with a unique message, catchy sound, and inspiring lyrics. Stream, enjoy, and download the latest gospel music from Holuwa.
Lyrics
My dear binu, Siri Cast me
Awon omoge ti mo kowale
Mo swear no be like that o
But Siri don open file, oh no!
No be my intention to bring Kemi come house
E happen as I dey one corner jeje, chilling at the bar
Kemi walk in, say I look familiar
Before I know, small gist don turn full gist
As the area she dey no safe to waka at night
She say “Abeg make I crash for your place”
When we reach, na so she greet Siri-“Hi, I’m Kemi”
And that one record am like FBI
My dear binu, Siri cast me
Awon omoge ti mo kowale
Mo swear no be like that o
But Siri don open my file, oh no!
Next day I no show for work, say I sick
Ebere come check on me, with hot jollof rice and juice
She sef say “Hi Siri”, like say dem be padi
Give me care, massage join, I no fit lie
Siri sabi talk, now my Siri dey snitch
My dear binu, Siri cast me
Awon omoge ti mo kowale
Mo swear no be like that oo
But Siri don open my yash, oh no!
Now my fiancée show, face like thunder
She say “Olsin, who be all these babes Siri dey mention?”
Siri dey cast me left and right
Baby it’s not what you think, na pure coincidence
Kemi na neighbour, Ebere na friend
Now you wan vex go-abeg don’t end this!
My dear binu, Siri cast me
Awon omoge ti mo kowale
Mo swear no be like that o
But Siri don open my file, oh no!
What do you feel about this post?
Like
Love
Happy
Haha
Sad